Hot Aproko Gist (Vol 2) with Angel Take It Inside don land!!!

Fellow Lailans, I greet una everyday and always.Uncle Andrew yakubu,I salute you....
All lailans born in the month of February,Happy birthday  to you all in advance.

#BringBackLailans....Na so some lailans just go solo after we hook dem up through "Connect and Chat". Anyways, make una show face ooo.



Enoma La Willy
Austin  La ........
Martha La David
John Anza La...

Back to the matter,who say Obinna no sabi take care of woman. Oya check this out. My guy sabi the
price of Xpression jawe...Obi, I sight u.


Wetin eyes no go read for this recession. Make una see how he do this bros.


Smh@to release self don cost. Lolz 

Mr Breeze, I hail you...
Na this kind comment we dey call "Words will type for LOVE....


Seyi Afolabi, who be that girl wey play with ur heart..pls forgive her  and show Lailan ladies some love. You too dey press p for women matter, biko take am easy and enjoy your val.


Lisa baby, no give them talk to yarn ooo. I remember how ur reply dey follow Mikeal own bumper to bumper...wey be say if he call you Boo Boo for 23.06, by 23.08, you self don reply..

Leboo boo boo....But since, MMM don MMM Mikeal, he come be like say ur Notification no dey active again....Anyways, na play I dey oooo.


Happy Valentine's day to you all in advance. Show some love.
To dem guys, please try control your third leg on vals day..."Una sabi the leg Bah? No say I  no tell you I look.
Have fun dearies....

Urs Truly, 
Angel take it inside 



Follow us on Twitter!

Like us on Facebook!

No comments:

DISCLAIMER : All Opinions expressed in comments are
those of the comment writers alone and does not
reflect or represent the views of Gidifun.com.


ALERT :Do You Wish To Advert with Us Contact +2348107127680 For Booking and Enquiries.

Powered by Blogger.